On Air Now

Skelele Mata

10:00am - 2:00pm

Two people die, Five oda people injure for Eko Bridge Accident.

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Two people die for inside accident wey involve six private cars for Eko Bridge on Wednesday.

Lagos State Traffic management Authority tok say five poeple injure for inside di accident.

LASTMA Spokesperson, Adebayo Taofiq, tok say from wetin dem find, one truck fail brake as e dey speed, e con go jam 5 oda people private car join one small bus.

LASTMA boss, Bolaji Oreagba want make motorists, especially truck drivers, to dey always make sure say dia vehicle dey in good shape before them go drive go any state.
 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 30°C | Low: 23°C