On Air Now

Go Slow Yarn

6:00pm - 11:00pm

Rivers 2023: E be like say Governor Wike know wetin we no know

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?
Rivers 2023: E be like say Governor Wike know wetin we no know

Rivers State governor, Nyesom Wike don talk one thing two times last month wey make am be like say he know something wey other people no know.

Rivers State governor, Nyesom Wike don talk one thing two times last month wey make am be like say he know something wey other people no know.

When Rivers United FC win league and he receive them, he talk am, and when he sign contract with Julius Berger for the Flyover wey go dey Rumuokwuta and location, he talk am too. And the way the thing sound, e be like say, e get wetin he know wey other people no sabi.

The day wey Rivers United FC carry Cup wey dem win for Nigeria League come give am, Governor Wike follow with Sim Fubara come.

As Wike start, he talk say, “I dey here with Sim Fubara, the next governor of Rivers State,” then he continue wetin he dey talk.

As Wike talk am, people just clap, but e be like say dem no underdstand wetin he tell dem.

E no tay, Wike and Julius Berger people bin dey talk about new Fly Over wey dem wan do for Port Harcourt and as he dey greet dem, Sim Fubara bin dey with am.

Again, Wike talk say, “I dey here with the next governor of Rivers State, Sim Fubara and e good say he dey here so he go dey see the kind projects wey I dey do and he go continue when he come.” 

But Wike add another thing after he introduce Sim Fubara. He talk say, “Because I no even sure say any body go contest with am.” 

Again, people wey dey there clap hand, but e be like say dem no understand wetin Governor Wike dey talk, or wetin he mean.

But wetin he really mean?

People dey look Wike as man wey dey talk anyhow. Maybe, this na because he no dey hide him mouth. Na as e be am for him mind he dey talk am. So, maybe, na wetin make dem no take him talk serious, dem just laugh because some kind things wey he dey talk dey make dem laugh, and even the way he dey talk am dey make dem laugh. But make we think am.

Na two times wey Wike don talk say Sim Fubara na the next governor of Rivers State. The second time he talk say he no sure say anybody dey contest against am. E fit be say Wike sabi wetin we no sabi o.

E get one bros wey sabi every every inside politics mata but he say make we no call him name. He talk say, sometimes Wike dey do like this, make opponent fear am. He dey feel say, no be every time wey Wike talk like this wey something dey come out.

“I dey feel say na one thing wey Wike dey do make him opponents dey shake for pant. No be today wey Wike begin talk like that,” our bros bin talk.

But he also add say Governor Wike na game man o. And game men dey sabi play this game wella, so e fit also be say Wike true true sabi wetin we nor know.

“Make we also no forget say governor Wike sabi this game wella. He sabi how to look opponent for politics, observe their mistake and how to use their mistake defeat them.

“He get plenty sabi men wey dey work with am, and wetin dem dey do na to dey look for mistakes wey opponents’ dey make. And these him sabi men, many na lawyers. The smallest mistake wey opponent go make wey go remove dem from election, Wike sabi men go tell am.”

Our paddy man wey tell us this thing also add say, if you check am, e be like say Wike dey court with almost all the parties wey get popular candidate for Rivers State. Accord o, APC o, Labour o and even SDP.

E be like wetin happen to APC for last elections fit happen to some political parties next year.

Remember say for last elections, APC no enter ballot paper at all.

We go dey look as area go be. Election still far, even though e no far like that.

 

Na China Acheru write am.

 

 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 24°C