On Air Now

Skelele Mata

10:00am - 2:00pm

Protest Burst For Di University of Jos Over Increase in School Fees

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Students of di University of Jos enta streets on Tuesday to show how dem no happy say dem increase dia school fees and oda services wey di school dey give.

Di protesters wey di  Student Union Government leaders organize dey demand say make dem change di fees back immediately.

Dem Carry diferent placards wey get messages like "If your children can afford the money, we can't" and "We don't want to drop out of school," na so di students dey shout.

Dem stress say Nigerians don already dey face serious hardships, and dis increase in fees go make mata worse.

Di students peaceful demonstrate bin cause traffic as dem block road wey pipo dey follow go di university campus.


How una see di mata?
#chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 30°C | Low: 23°C