On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Police Pipo Don Charge Lagos Forex Trader to Court For Stealing N221m From Six Investors

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Police don carry forex trader wey be Temitope Badmus, go court becos dem say him thief N221.6m from six investor.

Dem tok say di 36-year-old collect money from di pipo wey com report am give police, tok say him won put di money for Forex Online trading platform, PUNCH tok.

Dem carry Badmus go meet Magistrate A.O Salawu say him thief from six different pipo, so dem give six counts charge of stealing.

Di Lawyer wey come represent di pipo wey dem dupe, wey be Godwin Oriabure and J.Ebosereme wey dey join body with am for di case tok say wetin Badmus do break Section 280 and dem suppose punish am with Section 287 (9) of di Criminal Law of Lagos State, Nigeria, 2015.

Part of di charges tok say, ''Temitope Badmus from February 2022 to September 2022 for No 2,Taiwo Close, Surulere, Lagos, for di Lagos Magisterial District collect and thief by duping dem of di sum of 93,300,000 wey you suppose use trade with Forex Online trading platform, property of one Olademiji Akolade, meaning say you don commit offence''.

Badmus tok say him no commit di crime.

Magistrate Salawu, gree make dem bail am with di sum of N3m with two responsible guarantor wey get landed properties for Lagos State.

Dem shift di case go 23 of February, 2023.

#chookmouth

 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 32°C | Low: 24°C