On Air Now

Football Republik

2:00pm - 6:00pm

Police Don Comot Mohbad Bodi For Autopsy

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Di remains of di late singer, Ilerioluwa Olademeji Aloba, wey everibodi know as Mohbad, police don go carry eim bodi for autopsy for Lagos State.

Na Benjamin Hundeyin, the spokesman of the Lagos State Police Command na confirm dis one on Thursday. 

Hudenyin tok for one tweet say: "Exhumation completed. Autopsy to commence. #JusticeForMohad #Justice4Mohbad." 

Mohbad wey be 27 years old,die last week wey wetin cause him death neva still clear. 

Since him death,nigerians dey cry for justice as protest dey burst everiwhere for naija for justice for di singer.

Remember say Azeez Adeshina Fashola, a.k.a Naira Marley,police dey probe am for alleged assault and say eim hand dey for Mohbad's death.

Mohbad na former signee of Naira Marley's record label, Marlian Records.

How una see di mata?
#chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 30°C | Low: 23°C