On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Police Don Arrest Fake CP Wey Dupe Old Man N250m For Lagos

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Di Criminal Investigation Department, Lagos Command, don arrest 55-years-old Oluwole Akande becos say him dey pretend to be di Commissioner of Police, Railway Command, Yetunde Longe and duping one 80-years-old man of N250 million naira.

Longe wey confam di arrest on Wednesday, January 11, 2023 for Lagos tok say former Force Spokesperson CP Frank MBA, call her about di matter, Daily Trust tok.

She tok say di man wey dem dupe wife, call Mba to tell am about di so called plan of one CP Longe to collect millions of naira from her husband so dat dem go fit drop di report wey dey against am for her table.

CP Frank Mba tell di wife of di man wey dem dupe say him know CP Longe Yetunde well , say she no go fit do dat kind thing and he promise di woman say him go call Yetunde about di matter and him go get back to her.

 CP Frank Mba call me about di matter and I confam say di information na lie, I tell am say no report of such dey my table and I no even know di man wey dem dupe.

''Na dis time we tell State CID for Panti to trace di man wey dey claim to be me and dem come catch am. Him tok say true true, him dey do like say him be me,'' Longe tok.

Di man wey tok say him dey live for Ojokoro area for Lagos, tok say him start di duping business for 2022, and CP Longe na di only person wey him don pretend to be.

Akande tok say after him find di person wey him won dupe, him come frame am up for matter wey no concern am, him come call am, tell am say report dey about am for one illegal business wey him dey do.

He say na only him one dey run dis wayo business, and him still tok say him know say as him pretend to be CP Longe, say e go spoil her image but him bin no know say di plan go come back come catch am.

As dem continue to chook eyes for di matter, na im dey come find out say him don bin pay di wayo man N1.5 million and di wayo man still use other means take collect more money from di man wey him dey scam wey cum sum am to N250 million.

Di man wey him dupe sell two of him houses and him fuel station to fit pay di scammer until him wife come call CP Frank Mba , wey lead to di wayo man arrest.

#chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 32°C | Low: 24°C