On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Papa Dey Beg Polici Sai Make Dem Find Im Missing Pikin

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Ogunsinasi dey point finger at CSP Alex Igbosa, sai na im dey hold di mata...

 One pale for Rivers, Oluwaseyi Ogunsinasi, don dey cry out sai polici don dey drag leg for di mata of im daughta, Favour Oluwaseyi, wey dem cari comot since August 7, 2024, for Elelenwo, Obio/Akpor.

Favour na just 12 years dat time wey dem kidnap am. Di papa sai e don waka go police plenti times, beg dem make dem put more hand for di casala. For inside April 27 dis year, e even cari im famili waka go Rivers Police Command make dem remind dem polici about di pikin matter.

E tok sai na for June di Police Commissioner, Olugbenga Adepoju, com final final hear di mata, then e com move di case go State CID. But since den, di papa say no pass don set all for the case.

Ogunsinasi dey point finger at CSP Alex Igbosa, sai na im dey hold di mata. E accuse am sai e give one suspect bail wey e no suppose give, and even after di CP order, di suspect still neva show face for two months.

On August 7, exactly two years after dem carry im daughter, Ogunsinasi go meet di CP again. E sai di CP tell am sai e don comot hand for di mata, and sai e fit write petition go polici or anybody wey e feel say get hand for di case.

Di papa come dey ask if officer no obey di CP order, why dem no fit do anything about am?

Now, Ogunsinasi dey beg human-rights pipu, civil society groups, lawyers and good Naija people make dem help am find im daughter and make sure di matter no die like dat.

Our tok tok pesin con try reach CP Adepoju make e tok about di allegations, but e sai e no wan tok about di mata.

Comments

Add a comment

Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Light rain

    High: 28°C | Low: 23°C