On Air Now

Make We Praise Baba God

5:00am - 10:00am

Panic as Cult Wahala Kill One for Lagos

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Serious gbege happen for Omi-Ata area for Meiran, Lagos, as two rival cult groups clash and one person wey dem identify as Rahman die for the matter.

Tori pipo talk say di fight burst out on Monday when some cult boys, wey people believe say na Eiye, enter the area with weapon come dey find Rahman, wey dem say be member of Aye.

One resident wey talk with our reporter but no wan make we mention him name say Rahman see as di cult boys enter him family house and na so him japa. But di boys no give up — dem chase am enter another house for the area, catch am there, and dem cut am down till e die.

Di person talk say, “Rahman na Aye guy. Na Eiye boys kill am. Dem trace am reach him family house, as him see dem, him run. But dem chase am go one other house wey him hide. Na there dem catch am kill am. Dem even injure some other people for the house. After the matter, fear catch everybody. People just dey run anyhow.”

One online anti-cultism platform, NaijaConfra, also talk say Rahman death na like payback because dem don kill him padi, Chidi, before for the same area.

Dem talk say, “Rahman, wey be cultist, die Monday night for Agbelekale, near Meiran for Abule Egba side. People mention say na Aye and Eiye get the wahala. Chidi, him friend, don die for the same area earlier. After Chidi die, Rahman run comot, but him recently come back. Na Monday night dem kill am for Oyetoro Street, Omi Ata bus stop.”


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Light rain

    High: 23°C | Low: 20°C