On Air Now

Go Slow Yarn

6:00pm - 11:00pm

Oyetola Get Right To Go Court If Him Like - Adeleke

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Osun State Governor, Sen Ademola Adeleke don tok say di former Governor Adegboyega Oyetola get right to go Supreme Court if him no like wetin appellate court rule.

Di Court of Appeal for Abuja on Friday don tok say na Adeleke wey dey with Peoples Democratic Party (PDP) na him win di election as di governor of Osun State.

Di panel of di appellate court wey get three memebers, wey na Mohammed Shuaibu dey lead, sit down come tok say dem no gree with di result wey di election petition tribunal tok before say di governor victory no dey valid for January.

But Oyetola, tok for one statement wey na him media tok tok person, wey be Ismail Omipidan, tok say dem get di right to go reopen di matter for di Oga pata pata for all courts wey be Supreme Court.

When dem dey ask Adeleke for Arise News morning show on Monday, whether him dey fear say Oyetola won carry am go Supreme Court, him tok say, no, him no dey fear at all, him tok say him get him people for him side and him still get God for him side. Say if dem won go Supreme Court, make dem go, say dem get di right to go there. 

As soon as I hear di result from di Appeal Court, I try reach out and I call di former Governor Oyetola, say make we move ahead and move Osun State forward.

“But him never call me to congratulate me, I still dey hope say him go call me because we no get any other state wey no be Osun state. So, I dey ready. My hand dey open. Abeg, make we come together, move Osun state forward.”

#chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 24°C