On Air Now

Una Wake Up Show

5:00am - 10:00am

Nigerians don Get New President, Bola Ahmed Tinubu.

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Dem don swear Ahmed Bola Tinubu as di sixth President of Nigeria.

Di candidate of di All progressive Congress(APC) wey win di Presidential election on di 25th of February, 2023 don collect swearing fro Eagle Square on Monday morning afta eim take di oath of office.

Na di Chief Justice of Nigeria, Olukayode Ariwola give di oath for front of plenti ogas dem like former Presido, Muhammadu Buhari;eim vice,Yemi Osibanjo; and oda country Presidos.

Afta Presido Tinubu and him vice, Shettima don take dia oath, dem come sign all di papers dem need to sign.

INEC declare Tinubu and Shettima winners of di 2023 Presidential Election with 8,794,726 votes wey be 36.6 percent of all di valid votes wey pipo cast.

Atiku Abubakar of PDP be second with 6,984,520 votes, while Peter Obi of LP be third with 6,101,536 votes.

Atiku and Obi still dey court dey challenge dii result of di election. Dem tok say di mata get as e be and say Tinubu no qualify to run for President.

How you see di mata?
#chookmouth   

  


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 23°C