On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Nigerian First Female Senator Don Die At Di Age Of 79

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Senator Franca Afegbua family confirm say she die on Sunday.

Di family confirm dis one for di report wey dem give wey say: “Di Afegbua family of Edo state don confirm di death of di first woman senator for Nigeria, Senator Franca Afegbua, and dis sad thing happen today morning, wey be Sunday, March 12, 2023.

“She join beauty and brain when she dey serve Nigeria. We go let una know as soon as we don make di burial arrangement, di family tok.

Afegbua wey die at di 79, come from Okpella, one town wey dey for Etsako-east LGA of old Bendel state (wey dey don divide into Edo and Delta states).

Dem elect her as di senator wey dey represent Bendel-north for October 1983 under di National Party of Nigeria (NPN) for Nigeria second republic. But military coup of December 1983 cut her political journey short, when military overthrow di civilian government in less than three months wey she enter office. 

When dem ask her, how she take collect senatorial seat dat time wey na men na im full Nigerian politics,  Afegbua tell PLAC for one interview wey dey do for 2022 say everybody know say if woman tok say she go do something, she go do am. “Pipo know say women dey always keep deir promises and dis one na major fact, a big one. I bin plan to keep all my promise to my pipo, and I make sure say dem understand dat one,  Afegbua tok.

And I think ever since my time, I do see great changes. E get time wey be say woman no dey senate before me but after me, many women don dey there now. Dat time, I be di only woman but now, more than one woman dey there and I believe say di number of women for senate go continue to dey increase.

I remember di day, wey I enter office, I dey very happy but dat one no stop me to continue to dey carry di women and youths wey dey my community along. 

''My advice be say, anybody wey dey sure say dey won work for di pipo, make dem ready deir mind and make dem no lose focus and if dey dey serious about deir goal to help deir pipo, make dem come out try, cause dem fit dey successful.”

#chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 24°C