On Air Now

Sunday Gbadument

6:00pm - 10:00pm

NEMA Don Mention States Wey Flood Go Dey

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Di National Emergency Management Agency ( NEMA) don mention 14 states and 31 communities for Nigeria wey go get problem of heavy rain and plenti flood from July 4 to 8.

According to statement wey dem release on Wednesday by Mr Ibrahim Farinloye, di pesin wey be di Coordinator of di Lagos Territorial Office of di National Emergency Management Agency (NEMA),say ogbonge stakeholders wey dey for dis areas wey water go affect, dem don advise to prepare so pipo no go die and dia property no go destroy. 

Di states and communities wey dem say flood go shele na:

1. Plateau: Langtang and Shendam
2. Kano State: Sumaila and Tudun Wada
3. Sokoto State: Shagari, Goronyo, and Silame
4. Delta: Okwe
5. Kaduna State: Kachia
6. Akwa Ibom: Upenekang
7.  Adamawa: Mubi, Demsa, Song, Mayo-Belwa, Jimeta, and Yola
8. Katsina State: Katsina, Jibia, Kaita, and Bindawa
9. Kebbi State: Wara, Yelwa, and Gwandu
10. Zamfara: Shinkafi and Gummi
11. Borno: Briyel
12. Jigawa: Gwaram
13. Kwara: Jebba
14. Niger: Mashegu and Kontagora

How una see di mata?
#chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 30°C | Low: 23°C