On Air Now

Go Slow Yarn

6:00pm - 11:00pm

Nationwide Darkness Go Start as Electricity Workers don Strike

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

The National Union of Electricity Employees (NUEE) don start indefinite strike from today wey be Wednesday, August 17.

The union tok say e get several mata wey dey neva settle with the
Transmission Company of Nigeria (TCN).

NUEE tok dis serious mata on Tuesday afta dem gada go headquarters of the 
TCN inside Abuja

The Union's members don accuse federal government say dem fail to pay the 
entitlement of former staff of the defunct Power Holding Company of Nigeria
(PHCN) in December 2019.

Inside one circular wey the Union General Secretary, Joe Ajaero,
the circular tok say make all members withdraw dia services nationwide 
and make sure say all the activities of the TCN no work.

The TCN na the middle entity inside Nigeria's national power system.

Na dem dey responsible to give power from generation companies (GenCos)
to distribution companies (DisCos).

Na the TCN dey manage the national grid wey don collaspse not less dan 
six times inside 2022.

#Chookmouth tell us how you see dis mata


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 24°C