On Air Now

Go Slow Yarn

6:00pm - 11:00pm

Naija Soja don destroy 44 backyard refinery

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Soja dem wey dey for Operation Delta Safe don destroy 44 backyard place wey pipo for dey cook crude oyel for inside Niger Delta for the last two weeks.

The Tok tok Oga for Naija defence, Musa Danmadami tok say the soja dem hand still meet 29 oyel tif tif wey dey run things inside Delta, Bayelsa and Rivers state. 


Oga Danmadami Kon still tok say the soja dem kill about 13 IPOB and ESN members for the Southeast.


Oga Musa say soja dem for Operation AWATSE inside Southwest kolet 865 bad of 50kg bad of abroad rice wey pipo Kari pass backyard enta and dem seize 505 gallon of petrol. 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 24°C