On Air Now

Una Wake Up Show

5:00am - 10:00am

Naija Don Register 93.5 Million Pipo Wey Go Vote.

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Di Independent National Electoral Commission aka INEC tok say na 93,522,272 pipo don register plus di 9,518,188 new pipo wey just register to vote.

Na di INEC Chairman Prof. Mahmood Yakubu na eim tok dis one on Wednesday for di meeting wey dey happen every four month wit politcal party dem for inside Abuja. 

INEC tok say na 3.8 million wey be 40 percent of di new pipo wey register na student and di total percent of young pipo na 7.2 million wey be 76.5 percent.

Di Chairman tok say INEC dey work to make sure say dem complete di printing for di remaining PVC for di new pipo wey wan vote and for dos pipo wey follow apply for transfer or replacement for dia PVC wey lost or spoil.

 

How U See Di Mata? #chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 23°C