On Air Now

Una Wake Up Show

5:00am - 10:00am

LP Dey Plan To Do Nationwide Protest Because Of BVAS Access

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Labour Party don promise say dem go gather deir supporters for di whole country match go Independent National Electoral Commission (INEC) office on Monday if dem no gree make deir lawyers go chook eyes for di things wey dem use for di February 25 presidential election.

Dem give dis warning for di report wey na di chief spokesman of the Obi-Datti Presidential Campaign Council, Yunusa Tanko, sign on Saturday.

Dis one dey happen three days after INEC collect court order say make dem go recheck and rearrange di Bimodal Voters Accreditation System (BVAS) machines for di March 18 governorship and state Houses of Assembly elections.

Tanko believe say di commission won use ‘delay’ take stop Labour Party effort to show say true true dem rig di election.

LP spokesman dey tok say INEC dey disobey di court order for Presidential Election Petitions Tribunal wey give Obi and di party permission to check di original true certified copies of di materials wey dem used for di election.

He tok say di only reason wey Labour Party supporters never start to dey do protest na because dem no want make pipo see dem like say dey like wahala. 

#chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 24°C