On Air Now

Una Wake Up Show

5:00am - 10:00am

Lagos State Don Drop Traffic Plan For APC Mega Rally

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

General Manager, Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA), Mr Bolaji Oreagba, tok dis one for statement for Lagos on Sunday.

Oreagba tok say di march of APC Presidential Candidate, party supporters, go start from di local airport to Teslim Balogun Stadium to Mobolaji Bank Anthony Way, Maryland, Ikorodu Road

He say di march go pass Idi-Iroko, Anthony, Obanikoro, Onipanu, Fadeyi, Jibowu (Empire), Moshalashi, Ojuelegba, Barracks and Stadium.

Oreagba dey advise pipo wey dey drive make dem pass alternative routes.

He say from local airport to Maryland, make dem use: Kodesoh, Obafemi Awolowo Way, Kudirat Abiola Way, Old Oregun Road, Ojota, Maryland and connect to where dem dey go to.

From local airport to Ketu-Mile 12,  he advise make dem use: Kodesoh ,Obafemi Awolowo, Way Secretariat Road to Mobolaji Johnson Avenue (7-Up), Ojota Interchange(Ketu and connect where dem dey go to.

 

He say, to reduce traffic make pipo wey get cars use inconvenience and travel time before and during the procession, motorists could make use Ikorodu to Lagos, Lagos-Ibadan Expressway to Lagos/Oshodi use: Old Toll Gate, Alapere(Ogudu, Iyana Oworo,Third Mainland Bridge and connect to where dem dey go.

Oreagba say  from Apapa -Oshodi Expressway to Lagos, make dem use:

Oshodi Bridge, Anthony Bridge, Gbagada, Iyana Oworo Third Mainland bridge to connect to where dem dey go to.

He say from Ojuelegba- Surulere, make dem use: Lawanson -Itire Road, Ogunlana Drive, Akerele, Shitta Roundabout; Adeniran Ogunsaya, Bode Thomas; Masha, Adelabu, Census, Babs Animashaun, Bode Thomas or Doyin, Eric Moore, Abebe Village, Nigerian Breweries, Costain and connect where dem dey go to.  LASTMA boss say dey fit go from Masha to Kilo,

From Costain to Surulere, he say pipo wey get motor make dem use:

Costain, Iponri Estate, Bode Thomas and connect destination or from Costain to Abebe Village, Eric Moore, Doyin, Bode Thomas or Babs Animashaun Babs Animashaun,  Census around Adelabu in Masha and connect where dem dey go to.

 

How u see di mata? #chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 24°C