On Air Now

Koolele Zone

2:00pm - 6:00pm

Ikorodu-Ajegunle Pipu Dey Cry Make Government Help Dem!

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Pipu wey dey live for Ajegunle area of Ikorodu for inside Lagos state dey cry make the government come help dem put beta road, gutter for their area just like e be for other area inside the state.

The Baale of Ajegunle, Chief Moyosola Oladunjoye follow awa tori pesin Nnenna Okon wey enta the zanga tok say " Wetin dey disturb dem for the area na flooding wey dey happen when dem open Oyan dam and even wen water for atlantic increase"

Eim even tok say anoda tin wey dey give dem wahala for the area na say work no dey for the area. Chief Oladunjoye say plenti boy wey dey the area no get work. And if dem do the road for the area well e go help make job opportunate enta the area.

" if dem fit open this road go reach Irawo, den come give the boy for the area keke and okada to help dem dey make money for dem self"

The Community Development Administration (CDA) chairman of the area, wey be Sunday Awobona tok say eim don dey hustle make dem give build beta gutter and road for the area.

 

Eim also tok wey dem no get beta water for the area, dem dey go buy water wey dem dey use for the community. And for the community dem no get secondary school for their children.

" Children for the area dey go other far place, like Mile 12, and ketu just because dem wan go school." the say make government do well help dem because the suffer don too much.

Research wey Lagos Urban Studies Group join body with Nigerian Slum/Informal Settlement Federation do to take know where and where no get things like beta road, good gutter, and even beta water for inside Lagos state.

Show say ‘’36.1 percent of pipu inside the state dey get way from  trucks and water carriers and 25.4 percent dey buy water.’’

The Oga wey do this research na  Dr. Peter Elias, wey be senior lecturer for Department of Geography wey dey University of Lagos.

Dr. Elias believes say people wey dey live for inside zanga suppose also get beta road, water and good gutter self.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 24°C