On Air Now

Go Slow Yarn

6:00pm - 11:00pm

I Go Follow People Wey Want Biafra Tok - Obi

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Labour Party presido flag man Mr Peter Obi, don tok say the chair of presido for Nigeria no be place wey you come siddon relax and dey chop, that na why we countri need person wey get aka gum.

Obi yarn say eim no need to tell any body no vex because of eim get tigh hand, wetin we need to know na say na eim young pass, and eim still stronge and plus eim get wetin e take to fit siddon for the office of presido for inside Nigeria.

Eim tok this one when eim go All Saints Cathedral Field, Onitsha, Anambra State, as plenti people come out to show am support. 

The presido candidate still follow different kings, chief and other people wey get mouth for Anambra state yarn, when eim go government house, for Awka.

Eim still come tok Anambra na place wey dem dey do plenti buy-buy and sell-sell plus to they make things too. Dia Government go help ginger the business waka for the state and other places, for inside we obodo Naija so that everywhere inside Nigeria go come dey make different things.

Obi come tok say eim know say some people for Nigeria dey protest say dem want Biafra and other things. So if eim become presido dem go try follow dem tok to see if dem go calm down. 

But if dem no gree and still dey cause security gbege we go show dem say wey get government for inside Nigeria.

Eim come tell Nigeria people say dem no go fail for all the things wey dem yarn say dem go do. And if dem fail make Naija people hold dem for cloths.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 23°C