On Air Now

Una Wake Up Show

5:00am - 10:00am

Former Presido Buhari don go him final resting place

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Dem don bury former President Muhammadu Buhari for him house for Daura, Katsina State.

Na Vice Presido Kashim Shettima and some other people wey help put am for ground around 5:50 evening. Presido Bola Ahmed Tinubu and some big men follow the body reach Daura around 4:33 p.m. Dem do Islamic prayer for the place wey elokopta land before presido con lead people go where dem bury am.

Na senior military officers carry the body wey dem wrap with Nigeria flag enter the compound.

Buhari kpai on Sunday evening after he don sick for long. He kpai at the age of 82 for The London Clinic. Him family and some big men follow bring the body back come Nigeria, including vice presido Shettima.

The body first land for Katsina airport from London around 2:00 p.m, before dem carry am go Daura, wey be him hometown.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Light rain

    High: 25°C | Low: 21°C