On Air Now

Skelele Mata

10:00am - 2:00pm

FG Don Knack Fresh Charges On Top Emefiele Head.

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Di federal government don announce eim plan to knack 20 fresh charges on top Godwin Emefiele, di governor of the Central Bank of Nigeria (CBN) wey dem suspend.

Mohammed Abubakar,di Director of Public Prosecution(DPP)of di federation tok dis one for di Federal High Court for Ikoyi.

Di court Session postpone di hearing as per di mata wey government wan withdraw di charge of "illegal possesion of firearms" against Emefiele.

Wen di DPP dey tok to tori pipo, he tok say fresh 20 counts don dey di former CBN governor head wey dem file for di Federal High Court wey dey Federal Capital Territory(FCT).

Abubakar tok say dis application for withdrawal na becos dem need do more investigate for di mata.

Dis withdrawal fit lead to more charges to enta di mata for front, na so Abubakar take tok .  


How una see di mata?
#chookmouth 
 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 30°C | Low: 23°C