On Air Now

Saturday Flavour

6:00pm - 10:00pm

Exclusive: Tolu Arokodare Fit Soon Japa From Genk – England Dey Call!

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Tori don reach us say Naija striker Tolu Arokodare fit soon waka comot from Belgian club Genk as transfer market don dey hot.

Tori people don gather say clubs from Italy, Germany, and England don show serious interest in the player. But word be say na England dey Tolu mind pass — na there im wan go play ball.

As e be now, chance wey e go leave Belgium high well-well. Tolu and Genk don already get verbal agreement say if correct offer show, dem go allow am go sharp-sharp.

Di big striker don dey ball steady, and plenty scouts don dey monitor am. E be like say na small time remain before one big club table offer.

⏳⌛️ Make una dey watch — Tolu Arokodare fit soon enter Premier League level!


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Light rain

    High: 28°C | Low: 21°C