On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Electricity workers don suspend strike

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?
Electricity workers don suspend strike for two weeks

Electricity workers don suspend strike for two weeks

Electricity workers stop dia strike on Wednesday after dem do four-hours meeting wit federal government.

Di President-General of di Senior Staff Association of Electricity and Allied workers, Chika Ben tell  tori pesin for Abuja say dem go do anoda meeting afta di two-week suspension.

“Di issues wey we have; I thank di honorable Minister nd di Minister of State for Power for dia maturity as dem take handle issue wey we bring.

“Dem suppose solve di issues tey tey if dem follow every bodi tok about am.

“But as we don tok, dem don give us  two weeks maken we report back to di full house.

 Enugu Electricity Distribution Company (EEDC) Plc send out statement on Wednesday, say dem go stop to dey work.

Ikeja Electric and oda distribution companies don tell dia customers about di no light situation. 

.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 24°C