On Air Now

Skelele Mata

10:00am - 2:00pm

DSS Don Re arrest Emefiele Afta Dem Fight with Prison Officials

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Di Department of State Services (DSS) don re arrest di former CBN governor wey dey suspension, Godwin Emefiele.

DSS officials carry am afta one two fighting with di officers of di Nigerian Correctional Service of di Federal High Court for Ikoyi, Lagos.

Di two government join bodis bin dey fight ova who go hold CBN former governor.

Emefiele show for court on Tuesday morning as DSS carry am come on top two count charge of say Emefiele get guns and ammunition wey no legal.

He bin plead not guilty and Justice Nicholas Oweibo come grant am bail for N20 million.

Di judge bin also tok say Emefiele go stay prison till di bail don perfect.

Di officials of di prison bin carry Emefiele come outside di court when DSS officials stop dem say make di prison officials give dem Emefiele, as di prison officials no gree na so two fighting start and DSS come re arrest Emefiele.

How una see di mata?
#chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 30°C | Low: 23°C