On Air Now

Non Stop Music

11:00pm - 5:00am

DSS Do Mistake Take Arrest Me - Okupe

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

The Department of State Services (DSS) arrest the former Director General of the Obi-Datti Presidential Campaign Council, Doyin Okupe.

DSS Director of Public Relations, Peter Afunaya,tok this one say dem catch oga Okupe for Muritala Mohammed Airport, Lagos. And eim be wan enta Virgin Atlantic plane wey dey go London.  

Afunaya say na Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) naim eim say make dem help dem arrest Okupe. And as dem gbab am na so dem carry am give EFCC.

Oga Okupe lawyer, Tolu Babaleye, don come out come yarn say na true ooo, say EFCC arrest Okupe, wen eim wan go UK for medical checkup But dem don free am, becos the arrest na by mistake EFCC make.

The former Director, sef don go eim social media go post say EFCC don free am and say make eim no vex becos of the mata.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 35°C | Low: 24°C