On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Dem Don Use 18 Days Shift Rivers State Governorship Debate

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Rivers Debate Group na im tok say dem don change di date for di 2023 Rivers Governorship Debate.

Dem bin plan say, dem go do di debate for 1st of February 2023 but as e dey so, dem don shift am go 19th of February 2023.

Di president of di group wey be Ibifiri Bob Manuel, tok say di reason why dem change di date na so dat dem go fit bring peace between di governorship candidates for di day of di debate.

For di day of di Rivers 2023 Debate na five governorship candidate we go see and dem be, Accord Party, PDP, SDP, APC, and Labour Party, all of dem go come share deir vision of wetin go happen, if dem become di Governor of di state.

#chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 24°C