On Air Now

Go Slow Yarn

6:00pm - 11:00pm

Dem Attack Peter Obi For Katsina - Campaign Council

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Labour Party Presidential Campaign Council tok say dem attack deir candidate, wey be Peter Obi after deir rally for Katsina on Monday.

Di council head of media, Diran Onifade, give report about how di attack happen as Obi dey on him way to airport after di rally for di State.

''Our candidate bin meet with women for townhall and after that him come do rally wey go well for Muhammad Dikko Stadium'', according to di report.

But, as him dey go airport, some bad boys attack di motor wey him dey inside from di driver side with big stones, wey spoil di motor no be small.

To God be di glory, Obi and other pipo wey dey inside di motor no wound.

Before that one happen, another set of bad boy bin throw stones for di Stadium wey we dey do di rally come spoil plenty motor, including our official stage crew pipo motor. 

''Di two attack wey happen make us feel like say na desperate politicians wey tok say North-West dey on lock up plan am, as di amount of pipo wey show up for di Obidient movement for di region, shock dem.''

Di campaign council tok say di attack bad and dem also thank di ''good pipo of Katsina'' wey come show support for Obi campaign.

#chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 24°C