On Air Now

Sunday Gbadument

6:00pm - 10:00pm

Court No Gree For Nnamdi Kanu to Wear Him Traditional Cloth For Inside Custody

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

One Federal High Court for Abuja no gree for wetin di leader of the Indigenous People of Biafra (IPOB), Nnamdi Kanu to wear eim Igbo traditional attire, “Isi Agu” wen he dey custody.

Justice James Omotoso still stand ontop Kanu request say as dem no allow am wey wetin him like say na breaking of him fundamental human rights.

Di court still tok say di IPOB leader no fit prove wetin he write say him dey find for him suit.

"Di case of di applicant dey based on top wetin no get correct evidence, di suit no get merit, na eim make di suit no get approve" 

Na Department of State Service (DSS) hold Kanu since Kenya give am to di Nigerian Government for June 2021.

How una see di mata?
#chookmouth 


 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 30°C | Low: 23°C