On Air Now

Skelele Mata

10:00am - 2:00pm

Court Don Order DSS Say Make Dem Permit Nnamdi Kanu To Get Access to Doctors

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

For One federal high court meeting for Abuja dem don order di Department of State Services (DSS) say make dem permit Nnamdi Kanu wey bi di leader of di Indigenous People of Biafra (IPOB) access to doctors.

Di judgement wey Justice Binta Nyako  deliver,E give confam instruction say make di secret police record and keep eye for all di  medical sessions wey di IPOB leader go for security reasons.

On top of that, di court don dismiss   all wetin DSS dey protests about di mata, wey dey point say  Kanu wey dey detention nor get di right to receive beta medical  services. 

How una see dis mata??
#Chookmouth


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 30°C | Low: 23°C