On Air Now

Football Republik

2:00pm - 6:00pm

Nigeria Cinema Make N471m Inside July

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

The Cinema Exhibitors Association of Nigeria (CEAN) tok say dem make N471 million from ticket sales inside July. Dis amount mean say dem make extra N108 million increase inside box office sales from June. CEAN’s National Chairman, Ope Ajayi disclosed yarn dis one inside Lagos on Tuesday.

“The box office make total revenue of N471,679,856.00 for July, dat na extra from wetin we make from June wey be N363,274,999.00. Dis one na better thing,” na so him yarn am.

“Thor: Love & Thunder na the main main, e make ova 54% of the total box office revenue inside July and 69% of Hollywood, while ‘Ile Owo’ na Nollywood’s highest-grossing, as e make ova 4 percent.

“to think say movies for July na (31), compared to June (41), Nigerian cinemas grow wella for box office revenue by 30% if you compare both June & July.

The highest-grossing films in July were:

Thor: Love and Thunder
Minions 2: The Rise of Gru
Jurassic Work: Dominion
Ile Owo
Top Gun: Maverick

Mr. Ajayi say him fit beat him chest tok say Nigerian cinemas go do wella inside August.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Sunny intervals

    High: 33°C | Low: 24°C