On Air Now

Go Slow Yarn

6:00pm - 11:00pm

Aviation Boss Festus Keyamo Don Vex, Ban Ibom Air Passenger We Assault Crew, Ground Staff

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, don para wella as e order heavy punishment afta one female passenger for Ibom Airline flight from Uyo go Lagos misbehave, attack flight crew and ground staff.

Di passenger, wey dem identify as Ms. Comfort Emmanson (aka Comfort Bob), cause wahala for August 10, 2025, around 2:54pm for Flight Q153. According to wetin Ibom Airline talk, di gbege start because she no gree off her phone during take-off, wey no follow international aviation safety rules.

Keyamo talk say Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) don place indefinite ban for her head, both for local and international flights. Airport Police Command no waste time, dem carry am go Ikeja Magistrates Court this Monday morning, charge am for criminal offence, and remand am for Kirikiri Prison because she no fit provide correct sureties.

Authorities still confirm say small fight burst between di woman and ground workers before dem fit hold am down. Keyamo talk say e dey okay make dem record her bad behaviour use am for court, but e vex say person release di video wey show her private part to public. E call am “totally unacceptable” and don order make dem catch di staff wey leak am and punish am well.

Di Minister still give order say all airlines must train and retrain their workers on public relations and how to calm wahala before e turn serious. Next week, all security agencies for aviation sector go gather for joint meeting to improve coordination and quick response to this kain matter.

“For passengers wey vex or get complaint, NCAA Consumer Protection Directorate dey there to help. No be to take law for your hand because e fit end badly,” Keyamo yarn.

E warn say any passenger wey try this kain unruly behaviour again go chop heavy punishment — from long flight ban to criminal case for court.

This latest gbege na part of di recent cases wey dey make aviation safety and passenger behaviour dey under serious watch for Nigeria.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 29°C | Low: 20°C