On Air Now

Skelele Mata

10:00am - 2:00pm

Atiku Dey Ask Di Supreme Court to Cancel Di PEPT Judgment

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Di presidential candidate of di Peoples Democratic Party (PDP), Atiku Abubakar don ask di Supreme Court to cancel di judgment of di Presidential Election Petition Tribunal (PEPT),wey dem tok say na Bola Tinubu be di winner of di 2023 presidential election.

For one Notice of Appeal wey di former vice president file before di apex court, he put him argument on 35 grounds.

He dey tok say di PEPT commit serious mistakes and na injustice dey dia conclusion for di petition he carry put dor dia front. 

Na Atiku lead counsel, Chris Uche(SAN) file di appeal, wey dey ask di Supreme Court to leave di findings and conclusions of di Tribunal because e no show di true pictures of di grounds of him petition.

How una see di mata?
#chookmouth 
 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 30°C | Low: 23°C