On Air Now

Football Republik

2:00pm - 6:00pm

AIT/Raypower Pepo Dem Don Dey Fear Job Loss As Dem Comot Deir Mast for PortHarcourt

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Di transmitter mast of DAAR Communication Plc. don fall comot on Monday morning afta di officials of di Rivers State Government disconnect am on sunday and di mast fall yakata for ontop di di organization transmitter house.

Di Acting Head of Center DAAR Communication wey be Anthony Ekiko, don tok say if di company nor go fit transmit on top di disconnection wahala go affect 85% of e workers wey be Rivers State pepo dem.

Mr. Ekiko kon stil tok say Rivers State government nor tell di management of DAAR say dem dey com befor dem show face for di facility wit policemen.

“The Rivers State government invaded this place with armed policemen,” Mr. Ekiko tok.

“We cannot transmit because the mast is down and we have over 85 percent of indigenes working here.”

“Except something is done, I am afraid some persons may have to go because we cannot pay salaries at the end of the month,” he kon stil add.

How una see dis mata?
#chookmouth 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 30°C | Low: 23°C