On Air Now

Oga Madam Office

10:00am - 2:00pm

Karim Benzema don finally win Ballon d'or

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

The Frenchman wey dey play for Real Madrid don officially become di 2nd player since 2008 wey no be Ronaldo or Messi to win di Ballon d'or.

Benzema bin get one of eim best seasons as eim win UEFA Champions League, UEFA Super Cup, La Liga, Spanish Super Cup and finish top scorer for UEFA Champions League and La Liga.

Since 2008 na only Luka Modric for 2018 and Benzema dis year 2022 don fit break di Ronaldo-Messi dominance and Benzema don do am very convincingly with di kind doings ontop pitch wey eim display.

Sadio Mané bin finish 2nd winning di first ever Socrates Award for eim charitable works for Senegal.

Kevin de Bruyne di Manchester City player wey bin helep City win Premier League and also reach Champions League Semi-Final bin finish for 3rd posi.


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 23°C