On Air Now

Una Wake Up Show

5:00am - 10:00am

Falconet's don beat France for FIFA U-20 WWC

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Nigeria's Falconets don start di 2022 FIFA Women's World Cup with a big win over France.

France don collect as Nigeria's Falconets bin win di Group C opening game for di tournament wey dey shele for inside Costa Rica. 

Di referee bin pause di match after 20 minutes because rain no bin gree but dis one no affect di Falconets as dem bin defend well for di remaining first half.

For inside second half, Falconets start to dey attack France on di counter like say tomorrow no dey. As France come score one goal wey VAR cancel, na so Falconets eye come open and dem come score for 85th minute.

Dis victory dey totori naija people body sake of say France be di European Champions.

Anyway, Falconets gast focus becasue di work neva finish as dem go enta pitch again on Sunday, August 14 by 9PM Nigerian time against South Korea.

 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 24°C