On Air Now

Koolele Zone

2:00pm - 6:00pm

Di official 2022 FIFA World Cup ball no go 'work' until dem charge am

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Addidas make di ball with brand new technology wey dem dey use for di first time ontop di biggest stage of Football.

Di 2022 FIFA World Cup dey filled with surprises and right now, no be surprise say even di official match ball ghast dey charged before dem go fit use am.

Di ball wey Addidas call ‘Al Rihla’ (meaning 'The Journey for oyibo) get sensor inside wey dey helep officials sabi di position of di ball and external force on di ball.

Di informate wey di ball dey give dey helep referees make more accurate offside decisions. 

For dis tournament, di technology don helep Bruno Fernandes get goal as without di ball, na Ronaldo FIFA for award di opening goal for di 2nd group stage match wey Portugal play against Uruguay. 

Di ball dey light for weight and fit last for 6 complete hours after full charging.
 

 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 24°C