On Air Now

Yester Years

5:00am - 10:00am

NA LIE! Ngige No Warn APC Make Dem No Celebrate Di Presido Election Victory

You are viewing content from Wazobia FM Port-Harcourt. Would you like to make this your preferred location?

Claim: Chris Ngige bin advise APC make dem no celebrate di presidential election victory because of him experience for court with Peter Obi. Verdict: NA LIE. As we confirm from di spokesperson of Ngige wey talk say di minister no make dis kind statement.

 

Full Text

Reactions don continue since di Independent National Electoral Commission (INEC) declare Bola Ahmed Tinubu of the ruling All Progressive Congress (APC) the winner of Nigeria's February 25, 2023, presidential election. 

 

Some of dis reactions dey claim to be true for, here, here and here. For another time, dis claim no be true for, here, here and here.  

 

One of dis kind claim na di twitter post by Gabriel Chima (@gabrielchimam) for March 21,2023. For inside di tweet,Mr Chima claim say di Minister of Labour and Employment, Chris Ngige, tell APC make dem never celebrate di presidential election because of him experience with Peter Obi for court.

 

Di Twitter account use one photo of Mr Ngige as him dey answer question from journalist to carry support di  tweet

 

"I bin tell APC make dem never celebrate di presidential election because na only me know wetin my eyes see for Peter Obi hand during our court case” na wetin di quote talk.

Remember say after INEC declare Mr Ngige of PDP as governor-elect for di April 19, 2003 governorship election for Anambra State, Mr Obi, wey follow contest di election under All Progressive Grand Alliance (APGA), went to court to challenge the result. 

 

Him collect eim mandate back for March 17,2006 after di  Appeal Court ruling say na Mr Obi be di rightful winner for di April 19,2003 election. You fit get detail for dis account and long court fight wey Peter Obi chook leg for Anambra State for dis publication by Premium Times. 

 

As at March 22, 2023, @gabrielchimam tweet bin gather over 3,000 engagement, wey include views, likes, retweets and comments.

 

Meanwhile, some Twitter users for di comment section been show say dem no believe dis claim.


 

Twitter users' disbelief about di tweet and how e take spread everywhere na eim make DUBAWA go verify am.. 

 

Verification

We conduct one keyword search to discover if di claim dey for any credible news platform. We follow search for di quote for current news but e bin no dey .

 

We follow come discover say Mr Ngige no get any Twitter or Facebook account.

DUBAWA come contact di spokesperson of di Minister, Emmanuel Nzomiwu for WhatsApp, wey confirm say dis claim na lie. Mr Nzomiwu follow confirm ontop phone call say Mtr Ngige no dey active for social media .

 

"Na Fake news. No regard am, abeg. Thank you say una reach out," Na so Mr Nzomiwu talk.



 

Conclusion

Our finding and di message from Chris Ngige spokesperson, Emmanuel Nzomiwu, confirm say di quote about Mr Ngige na lie.



 

—--------------------------------------------------------------------------------------------------- 

The researcher produced this fact-check per the DUBAWA 2023 Kwame KariKari Fellowship partnership with the newsroom of Wazobia FM and Nigeria Info FM to facilitate the ethos of “truth” in journalism and enhance media literacy in the country.

 


Port Harcourt Weather

  • Port Harcourt

    Medium-level cloud

    High: 32°C | Low: 24°C