On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Papa Give Pikin Herpes After Eim Go Cheat Outside

Nothing person no go see for this world oooo, this kind mata wey come enta women's corner eh na real wa oooo. Papa give eim new born baby boy herpes after eim catch outside.

Cheche Smith tok sorry of woman wey her family dey vex for her because of gbege wey she hide from dem about wetin her husband do to dia pikin.

The woman husband go cheat on her, come get herpes wey be disease wey they spread wen person sleep with anoda person or kiss anoda person. Him no know say eim don get am come go carry dia pikin, na so the pikin take carry am.

After dem notice the sign for the pikin body Naim dem carry the pikin go hospital, the doctor say all of dem go do test. Na so dem see say na only the man get the disease.

The man come tell eim wife say na because eim cheat on her na how eim take get am. Now her family dey vex say she forgive the man after eim put the pikin and her for danger.

Na so Cheche come ask ontop Women's corner if the woman do bad as she forgive the man even though the man  put eim family for danger?

Watch to see wetin people wey chook mouth ontop the mata get to tok for the mata.

 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C