On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Even Me Self, For Put Hermes Up For Eviction - Khalid

Ismail “Khalid” Rukuba Ahalu and Ilebaye Odiniya wey be the two of the Big Brother Naija Season 7 “Level Up” housemate wey dem commot for biggie house with this weekend, carry waka enter we chookmouth studio

Dem come follow Cheche Smith yarn ontop Oga Madam Office show how dia waka for the house go and different things wey dia eye see for inside biggie house.

Cheche ask Khalid how eim feel when Hermes wey be one of the housemate wey eim really connect with nominate am for eviction. Khalid tok say e no shock am because eim know say na game dey play. One person naim go win show. 

Eim come still yarn say even if naim dey Hermes position, himself go line dem up like chicken come put dem for eviction.

Wen Cheche come ask  Ilebaye about Dotun and if she wish say she get enough time to fit know am more before dem commot for the house. Ilebaye yarn say yes dem for be close paddy, but she no dey sure about relationship, because Dotun no be her spec for man.

Oya watch the full video of the siddon tok


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C