On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

You Fit Still Dey Use Di Old Naira Notes- Supreme Court

Supreme Court don tok say make dem still dey use di old N200, N500, and N1,000 notes for Naija until dem tok anoda thing.

For di judgement wey Supreme Court deliver on Wednesday, dem tok say make both old and new Naira notes still dey legal tender until Federal Government set up process to replace or redesign am, after dem don do proper tok-tok with people for di matter.

Remember say Federal Government, through Minister of Justice Lateef Fagbemi, carry di matter go Supreme Court, say make dem extend di time wey dem go use di notes. Dem bin don tok say make dem comot di notes by December 31st, 2023.


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C