On Air Now

Music

1:00am - 6:00am

WWE legend Hulk Hogan don Kpai

Ogbonge wrestler, Hulk Hogan, don kpai o.

 

Di wrestling icon wey im real name na Terry Gene Bollea, die for im house wey dey Clearwater, Florida, after e get cardiac arrest.

According to tori wey come from America media, emergency people rush go Hogan house Thursday morning after dem receive distress call. Paramedics and police van full outside im compound, before dem carry di former world champion comot for stretcher, enter ambulance.

Hogan, wey many people sabi as one of di greatest wrestlers ever, blow worldwide for 1980s and 1990s. E headline plenty WWE (wey dem dey call WWF that time) shows with matches wey pipo no go ever forget and im big persona.

E “Hulkamania” era make am become cultural icon — e dey sell out arenas and rule pay-per-view shows for many years.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 29°C | Low: 24°C