On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Wizkid More Love Less Ego concert for London 29th July na the real ‘’We Rise By Lifting Others’’

Dj tunez, Wande Coal, Ms Banks, Darkoo, Masego, Skylar Tyla, Lax and even The cavemen na some of the artists wey open stage for Wizkid show wey happen for inside Tottenham Stadium for London.

Wizkid perform for 45 minutes for inside the stadium for the United Kingdom wey about 80 thousand fans full am.

 Other musicians, celebrities and footballers sef still come show am love for di concert.

As di concert dey go on, other celebrities like Seyi Vibez, P Prime, Rahman Jago, Rexxie and Bankuli stay backstage dey support wiz          

Wizkid perform songs from four of him popular albums, wey include the very first one wey eim drop Superstar, AYO wey get songs like Ojuelegba and the Grammy-nominated Made in Lagos.

Many of eim fans wey come the show, come online tok about our dem love Wizkid performance for the show.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 25°C