On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

We Go Start To Give Student Loan From January 2024 - Presido Tinubu

President Bola Tinubu don yarn say dem go start to use the student loan plan for January 2024.

The President tok this one wen eim dey talk for the 29th edition of the annual Nigerian Economic Summit for Abuja.

"Eim say, na by January 2024, we go begin use the new student loan plan. 

Presido still tok say our pikin and students na our future, So strike no suppose dey disturb dia school.

Also to make am easy for pipu wey one buy things dem go do one Consumer Credit Scheme wey go begin operate as soon as possible.

"We no fit dey yarn about anti-corruption waka when person dey find money to buy motor and e no get a better way to buy house,".

You remember say on June 12, 2023, President Tinubu sign the student loan bill into law. Eim bin don nack hand for chest tok say eim go do am during eim presidential campaign.

The Speaker of the 9th House of Representatives, Femi Gbajabiamila, wey be Chief of Staff to the President now, na eim bin sponsor the bill. The bill plan na to make am easy for poor Nigerians to fit go higher education through loan wey dem no go get interest from the Nigerian Education Loan Fund


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 33°C | Low: 26°C