On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

VP Shettima Go Head National Economic Council

Di meeting for di National Economic Council [NEC] go shele for Presidential villa Abuja on Thursday.

Di meeting go happen by 10am and pesin wey go head am na Vice president Kashim Shettima.

President Bola Tinubu na him open dis council on 15 June and di mandate na to wake and help Nigeria economy.                            

Di National Economic Council na constitutional institute wey kontain all di state governor, di Central Bank of Nigeria governor, and di other government officials wey dem involve.

How you see di mata? #chookmouth                               


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C