On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Vote Government Wey Education Dey Important to - ASUU President

Di National President of the Academic Staff Union of Universities (ASUU), Prof Emmanuel Osodeke dey ginger Nigerians to vote for leaders wey go make education number one for Nigeria and no be dose ones wey go treat am anyhow.

Prof Osodeke tok say, Nigerians must join hand tok say future leaders of we country must bring deir children come back to Nigeria to come do deir University. He tok say 2023 election na big opportunity for Nigeria pipo to choose leaders wey believe in di country and no be di ones wey dey thief “our commonwealth.”

Prof Osodoke tok dis one for di weekend of di 14th Ralph Opara Memorial Lecture wey na di National Association of Seadogs( Pyrates Confraternity) organise with di topics wey be: ‘Di State of University Education for Nigeria: Identifying Historical Issues and Misconceptions; Contemplating Solutions’ for Akin Deko Auditorium, University of Benin, and dem list six wahala wey education dey face for Nigeria.

Osodeke wey tok enter Nigeria history tok about di Structural Adjustment Programme wey World Bank and the International Monetary Fund introduce give di country tok say to introduce political matter inside who go dey incharge of Universities go dey very bad. “Members of Councils and even di Pro-Chancellors suppose to be people wey go add knowledge and dey able to find money for di University. As e be now, to get seat inside di Governing Council don dey base on politics and to create jobs for di jobless politicians. Today, members of di Governing Councils dey more interested for di money wey dem dey pay dem, work for deir family and friends, and di award of contracts.

“E dey sad and shameful say di appointment of Vice-Chancellors don become political appointments. Dem don dey control di process with emotions, politics, religion, culture, and “son-of-the-soil” wahala, godfatherism, and regionalism. For 1970s and 1980s, dem dey choose Vice-Chancellors without political and tribal reasons; say den, Professor Kenneth Dike go fit be di Vice-Chancellor of di University of Ibadan. But today, to choose di Vice-Chancellors for University don dey based on where di persin come from and sometimes with political Godfather wey go dey tok how dem go manage di University money without thinking about Nigerians.”

He still tok say, make dem arrange fresh thinking for aspect of how dem dey manage di university money, and make government and political pipo no dey chook mouth for university matter and make dem allow Universities to work well.

For him welcome tok, di National Association of Seadogs (NAS) Oga, Mr Abiola Owoaje tok say Ralph Opara Memorial Lecture na deir new meeting point to dey chook eyes for national and international matter.

He tok say di topic wey dem choose show '' deir deep concern for di corruption wey Nigerian Universities dey suffer”.

Many of us go school for Nigeria when our Universities make learning number one, when dem get passion for education, and dem dey about learning and making Nigeria great small small. Now di condition of things dey pitful. Our learning grounds don turn to place for gangsters, supporting criminal activities and violence. Di worse part be say, Nigerian Governments just dey lie about di development of education.

#chookmouth

 

 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C