On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Video Of Protest For Kwara Na Old Video - Emir Of Kwara

Emir of Kwara State, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari, don yarn say  di video wey dem trend say protesters enta eim palace come dey protest against presido Tinubu no be true. Eim come tok say na old video, and di protest na about the way wey thing take hard for countri.

Di tok-tok pesin of the Emir, Mallam Abdulazeez Arowona, tok say the video wey dey go up and down online been happen for 2019 during the general election.

For inside the video, you go see protesters, wey many of dem na youths, dey shout for Yoruba language, "Ebin palu" (country dey hungry). Di video spread well-well for social media, and many people dey think say di protest happun on Saturday because of di current economic wahala for di country.

Nigeria dey face security challenges, currency devaluation, and prices of tins dey go up. Na im make people for Ogun, Sokoto, Niger, and Kano states waka come outside stage protest against di economic crisis.

Labour union don also talk say dem go do nationwide protest on February 27 and 28 sake of di high cost of living for di country.


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C