On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

UPDATE: Four Persons Naim Dey Rescue From Kubwa Collapse Building

Four pipu naim dem don rescuse for one of the collapsed building on friday, For inside Kubwa area of Abuja nigeria capital according to local tori.

Two other pipu still dey trapped as of 1pm

Di tori say di director of di FCT Department for Development control , Mukthar Galadima tok say di building fall minutes before midnight on thursday.

According as him tok, Report show say di building dey ontop poto poto land and di  materials no too strong.
 
 "The mata wey dey important pass na say we don ready Rescue operation sake of say two pipu still dey trapped while we don rescue four pipu comot"  

"We dey look inside wetin cause di collapse and becos say na poto poto area, Officials of the National Emergency Management Agency, Fire Service, the Nigerian Securities and Civil Defense Corps (NSCDC) and the Police still dey try rescue and also chook eyes for the Site.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C