On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Two Chibok Girls Don Escape From Sambisa

Two of di Chibok schoolgirls don escape from di pipo wey kidnap dem.

Tok tok pipol don confirm say two girls escape from Sambisa forest on Sunday, dis one happen becoz of strong military wey burst di place.

One security pesin tok say di girls wey escape na Hauwa Mutah and Esther Markus. Him still tok say, one na from Chibok and di oda one na from Dziland village. Dis one don make di number of Chibok Schoolgirls wey still dey Sambisa turn 96 from 98.

Di head of di Intelligence Unit of di Joint Military Task Force, Operation Hadinkai, Colonel Obinna Ezuipke, give di number of di remainig Chibok girls as 98. He still break am down, "Out of 276 chibok girls wey Boko Haram carry, 57 escape for 2014, dem release 107 girls for 2018. 3 girls comot for 2019, 2 for 2021 and dem rescue 9 for 2022, dat one na total of 178 girls wey don free and e remain 98 for Boko Haram hand.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C