On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Tinubu Give INEC Fake Result- Atiku Lawyer

The lawyer wey dey represents di presidential candidate of di Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar, don tok say President Bola Tinubu give the Independent National Electoral Commission (INEC) fake certificate for di 2023 presidential election.

For one siddon tok with tori pipu wey eim do for Abuja on Thursday, Kalu Kalu tok plenti things against Tinubu.

E talk say, "Di certificate from South West College to Chicago State University wey dem take qualify e no get Bola Ahmed Tinubu name on top, instead e get woman name."

E still talk say, "Di Chicago State University admission application form talk say Bola Ahmed Tinubu go Government College Lagos and e graduate for 1970, but di school no even dey by dat time; dem open the school for 1974."

"Di same document talk say di person wey own di certificate na black American, and for di document wey Bola Ahmed Tinubu give INEC, e talk say e no get dual citizenship, wey mean say di certificate no belong to am," Kalu talk.

Wen dem ask am about if di document go dem go fit use am as evidence for Supreme Court, di lawyer talk say, "E dey very clear say from di way Supreme Court don already set, dem fit accept new evidence from any party as long as dem meet some conditions. From wetin dem see for inside the US court, e be like say dem don meet di conditions."

Former Vice President Atiku Abubakar dey try make Supreme Court cancel the result of di election wey make President Tinubu win after Presidential Election Tribunal bin throw-way eim petition say e no get strong proof say election mago-mago happen.


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C