On Air Now

Una Wake Up Show

4:00am - 9:00am

Tinubu Don Order New Sanctions on Top Niger

Presido Bola Tinubu don tell di acting governor of di Central Bank of Nigeria (CBN) to knack new financial sanctions to di ones wey first dey on top Niger Republic.

Di special adviser to Presido on top media and publicity, Anjuri Ngelare announce dis one to tok tok pipo wey dey State House on Tuesday. She tok say di new sanctions na di military junta e target and any group wey get hand for di coup.

Ngelare tok say, “I go fit report say afta di deadline wey first dey and di oda finiancial sanctions wey dey on top di military junta for Niger Republic by the join bodi of ECOWAS Heads of State, His Excellency, Presido Bola Ahmed Tinubu don order additional sanctions tru di Central Bank of Nigeria (CBN) on top all di pipo and join bodi wey follow di military junta in Niger Republic,” 

He still tok say all di decisions wey di join bodi ddey take no be personal decision of Presiddo Tinubu of of Nigeria against Niger.

Ngelare still add say ECOWAS go still follow Niger tok on top di mata of di coup and ECOWAS go still do siddon discuss for Abuja on Thursday.

Ngelare come tok say, "As Presido Bola Tinubu don become ECOWAS chairman, di position go tok wetin be di position of di member heads of state and coup no fit happen for person backyard make e no know"

How una see di mata?
#chookmouth   
 


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 32°C | Low: 25°C